Connect with us

World

Chef Smith cookathon: Guinness World Records confirm Ebenezer Smith from Ghana as new holder of longest cooking marathon – BBC News Pidgin

Published

on

Chef Smith cookathon: Guinness World Records confirm Ebenezer Smith from Ghana  as new holder of longest cooking marathon – BBC News Pidgin

Wia dis foto come from, MILLENIUM CHEF SMITH/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Millenium Chef Smith bin cook for more one month for di attempt for Accra

  • Author, Komla Adom
  • Role, Senior Journalist, BBC News Pidgin
  • Reporting from Accra

One chef for Ghana wey im name na Ebenezer Smith (aka Millenium Chef Smith) don become di latest Guinness world record holder for di longest cooking marathon.

Chef Smith get di record afta im cook for 802 hours 25 minutes.

Millenium Chef smith beat di record wey one Irish chef Alan Fisher bin dey hold wey be 119 hours 57 minutes.

Bifor now, Alan wey get restaurant for Japan break Nigerian Chef Hilda Baci im record of 93 hours 11 minutes.

Afta nine days of baking and cooking, Alan make 357 kg worth of soda bread and 590kg worth of dishes (3,360 portions wit 32 recipes).

At di time, Hilda Baci tweet to congratulate Alan Fisher afta im break her record.

“Huge congratulations to Alan Fisher. 119 hours and 57 mins na huge achievement. I wish am all di best as di new record holder,” Hilda write for Twitter formerly know as X.

Di certificate and Chef Smith

Wia dis foto come from, MX24/MILLENIUM CHEF SMITH/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Di record wey Millenium Chef Smith don set na 802 hours 25 minutes

But now di world get new record holder and na from Ghana!

For one press conference for Accra, Millenium Chef Smith present im certificate from Guinness world records.

On top di certificate dem write say “di longest cooking marathon (individual) is 802 hours 25 minutes and im bin dey achieved by Ebenezer Smith (Ghana) for Spintex, Accra – Ghana, from 1 February to 6 March 2024.”

Chef Smith wey don overjoy, tok for di press conference say “I tank everibodi wey support me for my attempt. Di pipo of Ghana support me wit some media houses.”

Im tok say afta di cookathon, dem pray well-well so di attempt go dey successful.

Millenium Chef Smith add say “today na very joyful day for my life. But sake of afta di cookathon, we neva fit do thank you tour sake of health reasons, but now wit dis record, we go begin di thank you tour.”

Plates of food

Wia dis foto come from, MILLENIUM CHEF SMITH/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Millenium chef smith bin prepare both local and continental food during di cookathon

For di three month period wey dem wait for feedback from di Guinness team, im den im assistant dey hopeful say good news go come.

“Even tho we get pipo coming around to support us, we focus on di rules, di five minutes break afta every hour and di fact say two meals get to be on fire at every time.”

Di press conference wey plenti media pipo attend, showcase di certificate about im successful attempt.

Dis na di second time Chef Smith dey apply to attempt di longest cooking marathon.

Di first time im apply na for June 2023 but im no get di approval from Guinness, wey im apply again for November of di same year.

Dis time, di approval come inside January 2024 wey im and di team begin to plan di cookathon.

For dis successful attempt, Chef Smith tok say for di videos dem submit, na 820 hours 20 minutes but afta di Guinness pipo do dia evaluation, dem carry di official time put 802 hours 25 minutes.

Chef Smith and im assistant

Wia dis foto come from, MILLENIUM CHEF SMITH/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Dem share di food for pipo wey come di venue wey dem take some give street children for Spintex and Accra

In di last seven months, plenti pipo don attempt to break one guinness world record or another for Ghana.

Media personality and enterpreneur Afua Asantewaa Aduonum attempt longest singing marathon for December 2023, but despite say im sing for 126 hours and 52 minutes during di Christmas festivities, afta three months, Guinness pipo write to am say im attempt dey unsuccessful sake of issues for di rest breaks.

Chef Faila also attempt di longest cooking marathon for Tamale for January wia she also cook for 227 hours.

But im attempt also fail as Guinness tok say dem breach di rules for rest breaks.

Only last month, one-year-old pickin get di record as di youngest male artist for di world afta Guinness confam im attempt.

Ace Liam bin attempt di record di time im dey one year four months, wey im do ova 20 paintings for one exhibition. Im also sell all di paintings wey be one of di requirement for di record.

One oda pesin Adu Sarfowaa attempt di longest speech marathon for 130 hours in February.

Im neva tok di public whether di attempt dey successful or im fail.

Continue Reading