Fashion
Isak Andic: Founder of fashion chain Mango die for mountain accident at age 71 – BBC News Pidgin
Isak Andic, di billionaire founder of high street fashion chain Mango, don die.
E die for an “accident” on Saturday, according to wetin di company tok.
Isak Andic dey known for im fashion chain but now, e don kpai at age 71.
Spanish media don report say di 71-year-old bin fall down for one narrow valley.
Tori be say im death come wen e dey hike for mountain range outside Barcelona.
Im son dey for di scene of di accident, according to di El Pais newspaper.
Di Turkish-born businessman bin start Mango for Barcelona in 1984 and di chain dey operate for 20 kontris.
According to Forbes estimation, Andic net worth dey around $4.5bn.
Mango CEO Toni Ruiz tok for di statement wey dem release for Saturday 14 December, say Isak na good example to many pipo and e don leave a good mark.
“Na wit deep regret we announce di unexpected death of Isak Andic, our non-executive Chairman and founder of Mango, for accident wey occur dis Saturday.
“Im departure leave a huge void but all of us dey, in some way, as part of im legacy and di testimony of im achievements.”
Ruiz add say dem go kontinue di legacy wey di late fashion icon leave behind so dem go fit make am proud.
“E dey up to us, and dis na di best tribute we fit make to Isak and which we go fulfill, to ensure say Mango kontinue to be di project wey Isak aspire to and of which e go dey feel proud of.”